Thursday, October 29, 2015

OONI OF COMEDY, LAFUP DON DEY GINGER AGAIN FOR HIM SHOW DIS YEAR

The biggest comedy show for Ibadan, wey Lafup "Segun Ogundipe" dey arrange don dey ginger to enter we dommot again dis year. The show Lafup live na the biggest comedy show for Ibadan as per say the persin wey dey behind the level na Made in IB, even though he don relocate himself to Lasgidi where he dey burst we head, dey do well, dey make us proud, dey roll with all the bigga boys for Naija entertainment industry. And as a guy wey no dey forget him source, he don make am tradition to always come back, come pay homage every December 26 wey be a day afta him byday. Last year na Lafup for Governor and he be like say dis year own na Ooni somtin, he no tell me o, na me just dey reason anyhow. So he don say make we dey expect am...So bros we dey wait o.

No comments: