Sunday Oni wey everybody wey sabi for Ibadan sabi as Eje dey hail Baba God today o, as per say the Baba no dey take am play ever since him mama born am 35 years ago. Na today 27th of October be him byday and no be for there the mata come finish, him darling wife too go dey celebrate her own tomorrow, see say na groove for dem dommot dis week.
Maybe you no even sabi say na Eje be the persin wey God sama the beta idea to start plus co-ordinate SHYLD, wey be Youth movement and dem dey try give youth of today brain, so dem go fit see road well. As Eje dey do that one na so he dey do him business for one side for him own company Broadnetconcepts. For all this things wey God don do am he wan celebrate today and he hey hall all of us make we come follow am groove for the Kings Kid Galilee Foundation wey dey for Iyana Ade-Oyo for Ring Road Ibadan, time na 4pm. oya na leggo....if I hear say I no dey there.

No comments:
Post a Comment