Wednesday, October 28, 2015

FINALLY FINALLY TRIBUNAL DON THROWAY BABA LADOJA MATA AGAINST AJIMOBI

So pariley pariley dem don throway am o, the mata wey Baba Ladoja carry go court say na lie Ajimobi no win the election wey do for April 11, 2015. Na yesterday Tribunal through dem chairmo, Justice Mayaki yarn say make we bone dat level o na Ajimobi win the election, and the mata wey Baba Ladoja carry come no get weight. So make himself bone, make he free Ajimobi make he dey chop igbadun dey go for Agodi, Government House. So we say congratulobia to Broda Isiaka. Maybe Baba Rashidi go waka go appeal we neva sabi sha.

No comments: