No be small mata o, groove neva stop for the dommot of we Gomina for Oyo State as per say Tribunal wey siddon for Oyo State don throway the mata wey Baba Rashidi Ladoja carry come say the election wey carry Ajimobi enter get K leg. Na so plenty associations dey go him office go dey hail am dey follow am do mukulu, and trust broda Isiaka na, himself dey ginger dey follow dem play, dey address dem. he don come advice Baba Rashidi say make he no waste him time go appeal o because if he go, na waste he go just go waste him time. See more fota afta under



No comments:
Post a Comment