Saturday, October 24, 2015

EEYAH TAYE FOR IBEJI ORAN WEY DEY DO YORUBA FILM DON KPAIN TOO

Na October last year, Kehinde ibeji oran kpain and exactly one year after, him twin broda Taiye too don kpain. Dem be actors wey dey do Yoruba films, dem bin dey with Alhaji Ajileye before Alhaji kpain. According to the tori wey TPN hear na some days ago Taiye kpain and dem don bury am for him house wey dey Owode for Ilesa, Osun State. TPN hear say dem don pass 40 small for age before dem kpain and Taiye get one pikin wey him former wife Folake born for am. We pray say make Baba God do dem dem well for dat side.

No comments: