Saturday, October 24, 2015

E BE LIKE SAY DON T DON RETURN TO RADIO WITH PETALS 102.3 FM

I no sure o, e be like say ni o. If wetin I dey smell na true den he be like say good pipu of Ibadan plus including Oyo State go once again enjoy the big voice of we own Don Tee, Tony Rowland Awobode. If you no sabi Don T for Ibadan, na him be say you be JJC, na dem first carry swag enter radio for Ibadan wen radio still get value for Ibadan, no be now wey radio station dey every corner. Don T na one of the pipu wey me sef learn from, in case una no sabi, even I no sure say himself sabi say na from him mouth I thief I LOVE YOU TO THE BONES plenty years ago. For some time now, na him private studio business he dey face since he commot from Splash after some plenty rumours, but e be like say Bros don come back to radio one kain one kain cos he dey retweet Petals FM anyhow and he even dey dem official commissioning yesterday. So make una dey observe am o cos me go like hear am again on radio. Bros na so? You hearrrrrrd cos Don T said so...lol

No comments: