Thursday, October 15, 2015

BABA OBASANJO SAY HE TOO DEY ENJOY AM WHEN PIPU DEY YAB AM

Na Yesterday OBJ yarn us like dat when he dey for one conference wey dem call African Studies Association of Africa wey shele for the International Conference Center for Ibadan. Obasanjo say him too dey enjoy as pipu dey yab am even when he be Presido, dat na why he get where he dey keep all the newspapers plus books where dem for yab am and he no dey take am cause quarrel with anybody as per say na dem get dem mouth, make dem dey run am anyhow. He say na try dem dey try tell am who him be, but as him don sabi who he be, he no get wetin he wan vex for, na so so laff and yeye he dey take dem do.

No comments: