Tuesday, September 22, 2015

WONDERS NO FIT END O...BABA OBASANJO DON WRITE STORY BOOK FOR CHILDREN

I no know wetin you think o but i believe say Baba OBJ na one persin wey dey enjoy life wella. Na everything wey enter him mind he dey do, he don go school, rule, fight war, now na book he dey write. He don write one wey cos gbege for the full country, now he don write anoda one for small pikins dem. The title of the book na 'Peace Story for Children' and na on the 'International Day of Peace' Baba release the book for him dommot. Toor my pipu the lesson from dis tori be say e never finish until e finish. You sef still fit do anything you wan do.

1 comment:

Unknown said...

No be today OBJ don dey write. I don read something about im book or say na article ni? Wey he call 'Unknown Soldier' i think dedicated to Ezeogu or something sha. E don tale wey i read about am o from my Papa's newspaper collection. Dat Baba dey motivate me to work hard now and wen i old i can then go back to all those things wey i really wan dey do. Na fulfilled life be dat my bros.