Wednesday, September 23, 2015

TINUBU NO GREE MAKE SENATORS WEY BE SARAKI’S PADI ENTER APC CAUCUS MEETING



No be small mata o, na God go fit save persin from pipu wey dey worry persin no dey hide do am. Na everybody sabi say Jagaban no gbadun the paroles of Bukola saraki, we Senate Presido. As per say Saraki don fall dem party hand when he wan become senate presido. Dat na why Jagaban, Tinubu no gree make senator from Ondo Tayo Alasoadura enter the meeting for South West Caucus wey dem do, dem say the guy dey collabo with Saraki dey spoil dem party, but the guy quickly thruway statement say no be so him dey loyal to the perty but now tori say dem see am follow saraki to Cose of Conduct tribunal wey confirm wetin Jagaban yarn.

No comments: