Friday, September 18, 2015

WHICH ONE BE ALAKOWE BUS AGAIN? WE SHA HEAR SAY E GO LAND FOR IBADAN ON OCTOBER 1

Na the question wey my pipu for Ibadan dey ask be dat o. Which one be Alakowe Bus again...I hear say na one kain beta bus wey go dey carry pipu travel and say the thing be like king palace cos he fine die and dem pimp am like say na Rolls Royce. Dem say make we dey look road dey expect am o cos na October 1 the levels go land for we backyard and dem go launch am. Many pipu don dey suspect sha say the thing get Splash FM hand for inside cos the way Splash pipu, especially Tope Fadeyi carry the mata for head, na like Timaya when he dey sell planytain. If dat na true, na him be say na 2 things Splash wan launch on October 1, Lagelu Fm plus Alakowe Bus...Oya na...leggo!

No comments: