Friday, September 18, 2015

CHOP FREE PRODUCTION AWOOF IF YOU FIT WIN IBUKUN FADUGBA (IBK) ONLINE MUSIC COMPETITION

One of we beta pikin for Ibadan wey dey sing gospel, infact wen we wan call God make he come down for anywhere with music, pipu talk say dis our guy oversabi. Apart from say the guy too good for him lane, he come still special join as per say him na afin (albino), he don start online competition for pipu wey wan show dem own talent too. To know how you go fit compete and win the prize wey be free production of your own music, go on top him facebook page Fadugba Ibukun go search for the details, e be like say you go sing one of him songs, Have your way Lord, upload your video on top him page and if pipu like your video pass na you win am. Oya o, best of luck. weldone IBK.

No comments: