
If you dey stay around UI, you go notice say something dey happen cos e just be like say dem don transfer Dugbe market come dat side ni. Na post UTME dey shele today plus tomorrow na him make pipu bombard the area from the full country. If you wan sabi dem, just enter UI, look your right abi left, you go see pipu wey carry big bad, dey shine eye like Daddy Showkey, na dem be dat. We wish dem beta luck. And happy holiday to pipu wey dey work for inside UI cos we hear say work no dey for dem today.
No comments:
Post a Comment