If dem tell me say Babatunde sabi anything about football, walahi i go argue cos na music, keyboard, MC, fine boy I sabi say him dey do when he bin dey Naija. But since he waka go capput for yonder, I don dey notice say Babatunde get some kain things to do with football. Na recently i come realize say the bros no wan play ball, na coach he dey do, and he don even collect certificate for the mata, to tell una say no be play play. But sha o, he still never drop him first love wey be music cos him still dey go show, dey arrange show for that side. Bros I hail o, you dey make brain, just dey learn the coach mata well well maybe na you we go take replace Oliseh when him cup don full.
No comments:
Post a Comment