Wetin persin no go hear for this Naija. One mama don dey para o say the
dean, Faculty of Law for University of Calabar, Prof. Cyril Ndifon don
take by force chop the dodo of her daughter for inside him office on
August 29th and dem don report the matter to the school and to police.
Dem say na gbanko the prof use for the girl, cos he vex tear the girl text paper say she no quick submit. Later na him he come see the girl say make she come him office come rewrite the text, na so he sha take scope am enter him office before he come take tipa tikuku chop her Ogbono. The university say dem don start dey shine light on top the mata but punch say as dem dey try halla the Prof reach he no gree pick him call. Na wa O!

No comments:
Post a Comment