Aluta shele yesterday wednesday for inside Unilag campus, wen student
dey vex for how one of dem padis, Oluchi Anekwe, who bin dey 300 Level
for Accountancy take kpef, dem say the babe sabi book no be small cos
until the timewey she kpain na first class she dey. Tori yarn us say na
NEPA wire, wey dem dey call high tension na him cut and fall on top the
girl wey dey come back from where she and her aburo go pray for church.
As dem dey come, na so Oluchi branch to sharperly buy something and na
wen she dey come back the killer wire fall for her head. The sister
raise alarm, students try carry her run go dem clinic and na for there
dem yarn dem say the babe don waka.
The students start to dey para say na dem school authority no do well cos if to say dem do normal ni dat kain thing for no shele, so dem lock gate dey sing aluta song take dey finish dem school authority. We hear say later dem VC, Prof Rahamon Bello come follow dem yarn for front of dem SUG building say make dem cool temper cos wetin shele na accident and even the wire wey fall no be for the school na NEPA property and no be today dem don dey yarn dem make dem come bury am, as dem do dem own for the school. But sha, dem go shile light on top the matter to make sure say that kain bad thing no shele again. we hear say the school don go greet dem Anejwe's family Eeyah for dem house wey dey Okota for Lasgidi. We pray make her jeje soul sleep well.
No comments:
Post a Comment