Friday, September 11, 2015

DEXTERITY PLUS DON FINALLY ENGAGE O...ALLELUYAH!

One of the bachelors wey babes dey eye pass for Ibadan, wey still be one of the baddest decorator for Naija and Oga patapata for Desterity Events Nigeria Limited don finally engage. Favour Essang wey plenty pipu sabi as Dexterity plus climb on top facebook yesterday 10th september go change him profile come take am polongo say one lucky babe don finally catch am. Wetin surprise persin for the mata be say na on 9th he talk am for facebook say him don dey relationship and he engage the babe sharperly the next day. Dat one mean say the wedding fit be next week o! Lol.......we say congratulobia bros as we dey wash belle dey wait for the marriage.

No comments: