
For those of una wey be lovers of Faaji...especially of that bros Samklef nonii...wey sing dat song Molowononii dat year, and him still be beta producer wey sabi wella. Tori dey yarn me say the bros go dey we dommot for Olympus dis thursday as him dey come for one groove wey dem call Balo and friends. No be only him o, our own pipu too go dey there, dem Keanzo (Omo Balogun), Portah, Pizzy, Shete, Pope Rapindaddy plus Mc Kwamz (omo iya elewa). So make una no dull am o, before dem talk again say Ibadan no dey try.
No comments:
Post a Comment