
Wednesday, September 16, 2015
NO BE SMALL SOMTIN...P SQUARE AND DEM BRODA GO BUY HOUSE FOR USA
Persin wey God don bless no man fit swear for am, even if na soundcity. Na him make dem P Square plus dem broda Jude wey still be dem manager climb on top twitter go flash us with the new house wey each of dem arrange. Na Paul first show him own before Peter come do him own even help dem broda show him own join. Na so Peter come still show the building wey dem houses dey and na dat one make some Naija pipu blood dey hot say why dem go show the full building wey be say no be dem get everytin. Maybe na everytin abi na somtin...all join. Una do well brodalys!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment