Saturday, September 26, 2015

ONE OF TPN BETA PERSIN MR. OBISANYA ADELEKE OBILEKE DEY THANK GOD SAY HE NO DIE 1 YEAR AGO.

To die no be small mata o, dat na why anybody wey don waka near death before go sabi how to hail Baba God. Dat na why I dey put my mouth join my broda Mr. Obisanya Adeleke Obileke for how Baba God take save am from one kain badt motor accident one year ago. This bros don dey show plenty love to The Pipu's News, infact i fit talk am say na him be our Number 1 fan cos he no get any of we post wey he no dey share. If you see the car, you go know say na God save my bros. Na 7 Alleluyah I talk on him behalf.

No comments: