
Wednesday, September 16, 2015
MAKE UNA NO COLLECT ILEYA RAM FROM FAYOSE O, IMAMS FOR EKITI DEY POLONGO
Awoof dey purge bele o, na wetin Imams for Ekiti dey polongo to all the muslims wey dey the State. Na yesterday we hear say dem do meeting for Ansar-u-deen Central Mosque, Odo-otu for Ado Ekiti. Dem say make muslims for the state no collect shishi talkless of rice or ileya meat from the Governor or any kain persin wey dey government. Wetin make dem yarn dat be say dem Governor no dey reason muslims for the appointments wey he dey do for the state. Na so dem yarn for inside the letter wey dem drop under the aburada of League of Imams and Alfas. No chop Haram o!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment