
Tuesday, September 29, 2015
NAIJA FM SAY MAKE IBADAN PIPU WULLUP O COS NA TEST TRANSMISSION DEM STILL DEY
If you don dey reason am say Naija FM dey make brain, dem say make you calm down o cos na test transmission dem still dey. Dem never start dem beta programmes wey dem go take totori dem pipu. According to wetin dem yarn for dem facebook page, dem say all dem OAPs don full ground berekete for dem backyard. I hear say dem don import plenty pipu wey dey scatter pidgin like say na beans. One of dem na one of the comedians wey dey make brain pass for Ibadan, PETERU plus including other pipu. He be like say I still dey smell Obadare Oladosu wey dey do sport for dem dommot. Oya na, make dem start make we know how far cos our mouth don dey water.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment