
Wednesday, September 30, 2015
HURRAY...DEM SAY OYO STATE WORKERS GO COLLECT 4 MONTH GBESE SALARY BEFORE FRIDAY
I pray make e be like dat o cos Oyo State don yarn say before friday, dem go clear the 4 month salary gbese wey dey dem neck. Na so NLC Oga for Oyo State, Comrade Olojede yarn News Agency of Nigeria. He say as dem don collect 26.6 billion Naira from federal government dem no go dull am at all, na sharperly dem go take am pay the gbese wey dey dem neck. I pray make e be like dat o. So all workerd for Oyo State make una never stop to pray o, until the alert land on top una phone...cos no be today dem don dey promise say dem go pay.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment