
Wednesday, September 30, 2015
NASO...DEM DON NOMINATE SMALL DOCTOR FOR HEADIES AWARD AGAINST OLAMIDE, REMINISCE etc
Anything wey you sabi do, just dey do am dey go, abi no be so? He sure me die say Small Doctor sef go shock when he hear say dem don nominate am for Headies Awards this year. Headies na the music award wey sure pass for Naija and na yesterday den release list of pipu wey go compete for awards this year. For the category wey dem call Best Street Hop, Small Doctor with his song Mosquito Killer go dey fight am with big boys like Olamide- Bobo, Reminisce-Skilashi, Falz-Ello Bae plus including indomie by masterkraft. Na later dis year dem go do the award proper.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment