Thursday, September 24, 2015

NA MAMA AWO CARRY ME COMMOT FROM WHERE I HIDE O...NA SO JONA YARN.

As beta pipu wey get surname for this country still dey go dem Awolowo house go hail dem for the death of Mama H.I.D. We former presido too don go hail dem yesterday and no be only him waka go o, him own jewel of inestimable value Mama Peace follow am go. Na for there bro Jona say him no plan to commot for house for one year before, but as e be so he gats break him promise. He hail the family say thank God for Mama o, cos he no easy make persin leave for 99 years. Walahi i dey miss this couple.

No comments: