Thursday, September 24, 2015

DEM SAY PIPU FALL BUKOLA SARAKI HAND, WHERE HE GO PRAY FOR ILORIN TODAY

No be small something, shebi dem dey talk am say home sweet home. Na him make we Senate Presido go Ilorin for Kwara make him too go follow him pipu do ileya. But tori wey dey commot from Ilorin talk say dem shout for am wen he show face for the place where dem dey pray for Eid. Dem say as some pipu dey hail am, na so some dey boo am and na so dem take carry their wahala disturb the normal prayer wey suppose shele jejenly. Na God go save us from we politicians and we fellow Naija pipu from ijekuje.

No comments: