Thursday, September 10, 2015

LWKMD...NEPA LIGHT FRUSTRATE SENATE COMMOT FROM WHERE DEM DEY PROBE POWER SECTOR


E be like magic yesterday when we senate siddon to shine light ontop how dem don take spend money on top our light for Naija and we still no dey get am. Tori yarn us say NEPA light no gree dem finish wetin dem dey do yesaterday cos dem just turn am to toy ni, dey on dey off am shere shere.

When e reach one level the Oga for the committee wey dey probe, Senator Abubakar Kyari, no get choise dan make he ask dem NEPA pipu wey dey there say shuuuu....na so una wan do am, shey na you call your office say make dem dey take the light play? Dem say as he turn that one finish, na so dem vexnation increase wey dem just dey take the light play. So tey na camera light na him dem take see before dem gats stop the meeting.

No comments: