Thursday, September 17, 2015

BAD MARKET, NA ONLY CHElSEA ESCAPE KOBOKO FOR CHAMPIONS LEAGUE

See as God dey work o, persin wey everybody dey expect say na him go fall dem hand na him come be the only person wey escape koboko. Na so all the English team and dem fans dey reason say na Mourinho and him boys go fumble but e be like surprise paso wen Dynamo Zagreb flog Arenal 2:1, PSV flog Man U 2:1, Juventus wey never win for dem own league come flog Man city wey never loose 1:2 for dem own dommot. Na only Chelsea come do well wen dem flog Maccabi Tel Aviv 4:0. Up Chelsea!!!

No comments: