
Saturday, September 26, 2015
IBADAN ORPHANAGE TOUR GO STILL SHELE TODAY O...AUNTY LANRE WELDONE
Baba God go kuku continue to dey bless pipu wey dey take care of other pipu, especially those wey no get. Dat na why me I know say persin like Aunty Lanre and her children wey dem never born no go fit beg for food lailai. For plenty weeks now, na him dem don dey waka from one orphanage to anoda go dey do beta for those children. So this saturday, 26th na still anoda day to go sama anoda orphanage home some goody goody. Where dem dey face dis time na His Heritage Home wey dey Olapade Agoro Bus Stop for Oluyole Ibadan. If you wan join dem abi you wan add your own join wetin dem wan go share, make you too for invest inside Baba God work halla dem on top 08166325461. God na him dey reward persin.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment