Wednesday, September 30, 2015
GREATER WORKS DON START FOR GLOBAL HARVEST WEY DEY JOGOR O
No be today dem don dey polongo o, say Global Harvest Church go do convention dis year to take celebrate 20 years wey the church start. Na yesterday, 28th the level start for Hall of Grace, the hall wey big pass for Jogor Center. Yesterday make sense die cos I dey dia with my 2 korokoro eyes. Rev. Victor Adeyemi plus including him wife wey fine die, Pst Mrs. Jumoke Adeyemi dey there as per say na dem dey host. Pastors wey dem invite follow dey, Pst Sam Adeyemi, wey be Pst Victor broda, Rev Albert Oduwole, Rev Gbeminiyi Eboda, Rev Gbenga Kotila plus including all other plenty beta pastors. Na so the mata go continue come reach Sunday. So if you never hear before you don hear am now o, no dull o. If you wan catch me na there I dey.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment