One of the comedians wey dey make brain for Ibadan and Naija, Anointed Mallam don ready to make all of una laff this sunday. This go be the second time wey him go do him show wey he call EXPLOSIVE SUNDAY.
Plenty comedians, musicians and dancers go dey the show, some of dem na KennyBlaq, Peteru, Laff Doctor, Honey Tongue, Mc Solid, Dr. Frick, Mc Above, Mc Rapindaddy, Arole, Diouf, Young Mc, Asiri, Babatunmise, Tee Dreads, Dare Anoda Level, Xpandables, Cymbals.....plus including one guest wey dem wan take do surprise.
The show go shele dis sunday for RCCG, Jesus Capital for Oluyole Ibadan by 2pm. Wetin come sweet pass be say na AWOOF!
No comments:
Post a Comment