Saturday, September 19, 2015

DEM DON NOMINATE RONKE GIWA FOR ONE BETA AWARD

Award na to ginger the ginger of pipu wey dey do well, no be so? That na why e no shock me say dem don nominate one of we beta pikin for radio, Ronke Giwa, wey her darling darling for radio dey call Ronnie G. The award wey dem call Beauty of Brains na to celebrate woman wey bone every yeye thing to standa gidigba for her own side. According to wetin Ronke put on top her facebook page, dem don nominate am and she go like am if you too fit do the same. So if you be her fan wey think say she don do well for herself go on top her facebook page go see the link wey you fit take nominate her. oya now, tiwa n tiwa.

No comments: