
The thing first start like play when we hear tori say code of Conduct Tribunal don carry we senate presido, Sai Bukky go court on top say he do magomago for the property wey he polongo say he get. But wen tribunal wan siddon yesterday, Mr. Senate presido no dey na him make the court vex throway command say make police go find am catch. Toor...shey dem go catch am abi dem no go catch am? make we siddon dey look like Lukuman.
No comments:
Post a Comment