Friday, September 18, 2015

NO BE FOR IBADAN DIS THIEF MATA FOR SHELE O, DEM SAY NA FOR LASGIDI

I for talk am na, say we no dey thief for Ibadan. But as persin no dey too old for wetin e no sabi, na him make me think say na only for Ibadan we get palms mall, I no know say dem still get am for Lagos (if you like call me bush man, na you sabi, shey Ibadan be like bush for your eye). Thank God for one of my Oga, Oga JayJay for Splash, wey yarn me the correct tori. But that one no mean say make we careless for Ibadan o...thief dey everywhere o...I talk my own sha. If the Oga Ole na your neighbor, tell am pele for me, make he no vex say I de-rep am say na for Ibadan he thief...lol

No comments: