![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEiJWQSq0RsskkEPTc6ewlAMDSq0cegYQjcdPD4wyo3AfbPS-iADPXnZ3pyWiFLHUId4SfZ29YasHT7cYsy0ZUv-ZO6kWMYMK9vWk2HYcdHOgK6uxNGQAC4pc5Lzs1iUEptDUrmjKE3iD6E/s320/%253D%253Futf-8%253FB%253FT3N1bi1TdGF0ZS1Hb3Z0Mi5qcGc%253D%253F%253D-774499)
Finally finally e be like say time don reach for Osun workers to smile and dance. Tori yarn us say dem don sign another agreement with dem State government yesterday and the state promise say dem go pay dem 3 month salaries plus including the ones wey remain for the half salaries wey dem pay earlier. So make dem dey wait for alert any time from now. E be like say na wetin PDP yarn say dem wan kolobi the bailout money make dem wake up like dat. We pray make e be like dat o, so Osun pipu go fit do beta ileya.
No comments:
Post a Comment