Thursday, September 17, 2015

ALLAHU AKBAR...COLLECT FAYOSE RAM CHOP AM WELL, IMAM FOR EKITI POLONGO AGAIN

Dem say make pipu for Ekiti bone the statement wey circulate yesterday say make dem no collect Ileya ram from Fayose or any of him padis. Dem say na lie say Fayose no dey do well for Muslims for Ekiti State cos dem get muslim senators, even Rep for Ekiti. Na the General Secretary for League of Imams and Alfas for Ekiti Alhaji Abdulrazak Adenipekun release the statement yesterday say make we throway the one wey him deputy Alhaji Oguntuase drop yesterday...Toor....Anakunmulahi...make wey dey chop ileya meat dey go!

No comments: