Russia don loud
am o, say the arms and ammunition wey one plane dey carry, wey dem come seize
for Aminu Kano International Airport, Kano, on Saturday say no be dem bgat am
o, na the belonged to the peace-keeping mission wey France dey do for Chad get
am o. Na the Russian Embassy for Abuja dey clear the mata like dat on top dem Twitter
handle on Sunday, dem come even explain say na hire dem hire the aircraft to
take move military equipment and apart from that sef, the pipu wey follow the
plane waka no be Russians.
The embassy yarn
say dem don dey do everythin wey dem go fit do to make sure say the plane plus
including wetin e carry go fit commot. Na dem Language wey be Russian dem take
write the tweets wey dem dey send sha but our pipu wey sabi don translate am to
English.
No comments:
Post a Comment