Monday, December 8, 2014

GHEN GHEN APC DON READY FOR DEM PRESIDENTIAL PRIMARIES.





Plans don ready for dem APC National Convention, na so dem Megaphone, National Publicity Secretary, Alhaji Lai Mohammed yarn. He say dem go start am tomorrow 10th of December come go end am on Thursday the 14th for Lagos. 
 
He make mouth well well for him statement say na dem party go fit give Naija the change wey we dey find, and na the election wey go happen next year bna him dem go use to take do the changes wey dem talk.  And na how dem go come take pick better persin wey go fit do am na him dem wan start so for dem primaries so make all of us dey watchout for dem and dem plenty promises.

No comments: