Man jailed for stealing at his brother’s
house
One
court wey dey siddon for Maiduguri on Monday don send one man go prison for 10
years on top say he do conspiracy and robbery. The badt guy, Kyari Bukar, na
from Ngomari ward for Maiduguri, dem sentence am under sections 97 and 298 of the
penal code law wey dem dey use for Borno State. Him padi wey follow am do the
bad thing dem give am too, 6 months for prison.
Tori
say the guy carry plenty dangerous weapons, like knives, cutlasses plus sticks,
take break enter the house of one Hauwa Ngomari and he thief her properties. According
to paper wey dem take carry am go court, the badt guy thief necklace, 4 phones,
gold earring plus one DVD machine, wey be say all of dem go be like N173,000.
The
persin wey carry the mata come court sef who dem say be the badt guy broad even
yarn the court say the accused reason am say he wan take by force chop the dodo
of one persin when he go hayaj dem.
No comments:
Post a Comment