GHEN GHEN…ORITSEJAFOR
CARRY FASHOLA GO COURT, ON TOP WETIN?
CAN President. Papa Ayo Oritsejafor don carry
Oga Governor for Lagos State Babatunde Fashola go court o, on top say
Government for Lasgidi dey plan say dem warn fall him church wey dey for Victoria
Island. Tori say government bin dey plan
say dem wan scatter the Word of Life Bible Church, wey dey for Plot 21E,
Abdulrahman Okene Close, Off LigaliAyorinde Street for Victoria Island Annex.
Other pipu wey papa carry join BRF to court na
the Oga Lawyer for the State, the Ministry of Physical Planning and Urban
Development; State Building Control Agency, State Physical Planning Permit Authority
plus including State Task Force on top Environmental Sanitation. For the mata
wey dey before Justice Deborah Oluwayemi
the pipu wey get Word of Life Bible Church, dey beg the court say make e stop the
state government make dem no fit fall, scatter, pafuka or chase dem commot from
the church.
No comments:
Post a Comment