Tuesday, November 18, 2014

SPEND PASS 1 BILLION NAIRA FOR CAMPAIGN MAKE YOU GO PRISON…INEC WARN POLITICIANS




INEC say dem don ready to dey monitor money wey we politicians and dem party go spend take campaign for this election wey go soon come. Dem say any presidential aspirant wey spend pass 1 billion naira go smell pepper. The Tatafo to INEC Chairman, Kayode Idowu na him yarn am on Monday for Abuja where dem dey commot ban wey dem bin put on top campaign.


Dem say according to section 91 of the Electoral Act, 2010, persin wey wan be president no suppose spend pass 1 Billion Naira and Governor no suppose spend pass 200 Million Naira, any body wey spend pass for presido go pay 1 million Naira or make he go prison for 12 months or make dem ask am make him do the two, for governor na 800,000 fine him go pay or make he go prison for 9 months.

No comments: