One small pikin wey never pass 8 months don free from the
badt guys wey bin kidnap am, dem say na for the Pentecostal church where dem
for kidnap am dem return am to on Friday, dem say the mama bin dey sing for
inside the choir wen one mama wey dem no know move the pikin.
But sha o, the pikin show face again on Friday around that
kain 7pm with one letter wey dem hang for him neck. For inside the letter na
him the thirf yarn say naone pastor ask am make she thief pikin and keep am for
14days say na if she do that one she go fit born her own pikin. And that na why
she bin carry the pikin o, say dem go even see say she take care of the baby
wella cos say God see her mind say she no wan do dem bad. But sha o she no fit
keep am for 14 days cos she hear say the pastor of the church where she for
move the pikin and dem members don swear for am. She come dey beg dem make dem
please thruway the curse and make dem pray for am so she go fit get her own
pikin.
No comments:
Post a Comment