Monday, November 17, 2014

LAGOS POLICE DON CATCH 2 FAKE LASTMA OFFICIALS FOR LASGIDI.





Police for Lagos state don catch 2 Gonfabis, funsho William and Adekogbe Olabode on top say dem dey form, dey ie say dem na LASTMA official. Punch metro hear say dem 2 go hold one 62 year old baba wey don retire, Mr. Felix Adesanya and say he gats pay dem 60,000 naira cos say he don disobey traffic law.


The baba wey retire from Federal Airport Authority of Nigeria say na LASUTH him dey go wen dem catch am, he say na Akilo area for Ogba Are na him dem for stop am and carry him 30,000 naira after dem don search him car, dem come yarn am again o, say if he no wan make dem seize hm car, make he pay another 30,000. Na so dem follow am go him ATM go collect anpother 5000 and as dem wan run na him the Baba shout and na so original LASTMA officials grab dem wen dem wan pick race. Dem say if no be for police and LASTMA, pipu for beat dem die.

No comments: