Police for Lasgidi don catch one 55 years old Alfa say na
him kpain him customer, one 62 year old mama wey dem don dey find since last month
for Olodi Apapa area for Lasgidi. Dem later dig commot from groud some things
wey belong to the mama from the shrine of the bad guy who say him name na
Isiaka Akanbi.
Tori yarn us say the mama wey die, Raliatu Kareem don go
hail the badt guy for him shrine wey dey Lawani Street, Olodi APapa on the 25th
of October before she miss, dem say na her family persin she go see for the
area before she yarn dem say she wan quickly go hail the badt guy. But she
shock o, wen dem call am after 2 dats say dem never see the woman and na so dem
take halla police. Oga megaphone for Police for Lasgidi, Kenneth Nwosu confirm
the matter o, say dem don catch the Alfa and investigation still dey waka on top
the matter.
No comments:
Post a Comment