Monday, November 17, 2014

FAMILY DEY PARA O SAY POLICE DON RELEASE PERSIN WEY KPAIN DEM PIKIN.





Pipu for Obi Abiniya family don dey para o, say dem no believe police again as dem no dey handle well the case of Asu Ochang who cut thruway the head of dem pikin, him own friend, on top say that one dey laff am, dey take am do yeye wen dem bin dey do Eti August festival for Boki Boshu Area of dem state, Cross River State.

Dem say the yeye pain the bad guy so tey he vex go him house go carry cutlass, come go cut 
him padi head for midnight wen  that one don gawk am dey sleep. Abibiya senior sister, Blessing say the tori wey dem dey hear be say Police don finish arrangement with bad guy family say dem go free am and na him make dem dey para, dey polongo make all of us for naija say make we hear o.

The Oga megaphone for police for the state, Hoggan bassey say na lie the guy still dey dem dommot and dem go carry am go court wen him file ready for DPP office cos say the guy don confess winsh say na true him cut him padi head.

No comments: