Monday, November 17, 2014

NA VIGILANTE GO DEY DO SECURITY FOR SCHOOLS NOW FOR BORNO O





Borno state Government don yarn on Sunday say dem don plan to dey use Vigilante now to do security for Public Schools wen dem resume on the 17th of November.


Dem dey expect say schools go re-open on 17th of November after dem don close am since march 16 because of the gbege and the kasala wey dey burst for dem area. Na so the chairman of the 19 pipu committee wey dey try arrange how dem primary schools go fit dey make sense yarn so. According to him, den go fence all schools and dey check pipu wey wan enter well well.

No comments: