Thursday, November 27, 2014

OUR JET NUMBER 6 DON LAND O, SHEY YOU HEAR…BISHOP OYEDEPO LOUD AM




For the pipu wey dey complain say him jets don too much, Baba Oyedepo the General Overseer of Living Faith Church (a.k.a. Winners Chapel) don loud am o, say dem number 6 jet for the ministry don show face.  He loud am during him message for the Annual Convention of Livingspring chapel International for Ibadan.


Tori even yarn us say the Baba explain say this one maybe na dem choir go dey take am groove, dey travel if dem get ministration as per say the jet wey dey ground don go round all dem top pastors. Likewise he even gist say some countries for West Africa don dey take style toast dem make dem come build school for dem. Toor….we say congratulation we go wash am o, abi no be so.

No comments: