Dem Oga prison officers on Wednesday don catch 2 sisters,
Shade Oyetobi and Atinuke Adebanwo wen dem dey try smuggle 11 wraps of Igbo
entere cell wey dey for Ikeja inside the Lagos state High Court for inmates wey
dey wait for trial.
Punch correspondent hear say na for dem brother Babatunde
Oyetobi wey dey wait for trial, even dem say dem no get parents again say dem
be orphan. According to dem den say the guy wey dem arrest during one street
fight don dey prison now for like 2 years. And na since den dem don dey come
court come see him for court. One of dem, shade who be 24 years old and
hairdresser say na one Jamiu who be dem brother friend carry am give dem say
make dem give dem brother. Dem other sister, who be 32 years old just dey cry
so so cry say she no know wetin happen o, cos her hand no dey o say her sister
don put am for trouble.
No comments:
Post a Comment