Friday, November 28, 2014

LIKE PLAY LIKE PLAY 63 SENATORS DON SIGN TO REMOVE UNCLE JONA O!

As of Thursday, like 63 senators don sign say make dem impeach we
Presido, Goodluck Jonathan for the senate, Na so one of the main
persin wey dey arrange the level dey gist Punch, he even carry the
signatures show dem. Tori still yarn say 8 PDP senators sef don join
hand put down signature say make dem commot we preside.
According to dem wetin preside do wey dey vex dem gangan be say he no
dey handle the economy and political mata of Naija well well.  For
example he say dem no arrange the budget well, and say for corruption,
Presido carry last. But sha o the one wey come bad pass na say him no
dey respect dem wey be Lawmakers for the country. He say him know say
the mata no go easy o, but dem don ready to show Uncle Jona pepper.

No comments: