Thursday, November 27, 2014

MY PRAYER JOIN WETIN MAKE DEM CLOSE LINDA IKEJI BLOG THAT TIME, PRINCESS CONFESS WINSH.





Since her marriage fall yakata, princess the comedian never stop to dey blame pipu wey dey operate blog and the media o, say na dem Devil use take scatter her marriage just after 7 months. But sha o dem say she carry am go higher on Sunday wen she dey yarn for the popular show Tyme Out with Tee A, say she go MFM go pray o abi na go swear for Linda and she happy o, because say as she come back na him she hear say google don close her blog.


She even yarn say she fine, pretty and sexy pass Linda Ikeji , say Linda wowo no be small. Na May last year she bin try marry one Adeshola Jeremiah and na after 7 months dem scatter dem marriage say dem no do again.

No comments: