
Friday, November 28, 2014
I NO DEY MISS CHURCH SERVICE O, ARMED ROBBER DEY CONFESS
One Armed Robber wey Police for Lagos catch, Felix Odion don dey
confess o, say make we bone the fact say hiom na thief o, he no dey
miss church service. Na SARS catch the guy with him partner Titus
Anthony on November 22nd for dem dommot where dem dey rule.
Accorcing to Police dem say na big big cars dem dey like to collect
from pipu, and dem don fit collect one of the cars for dem hand wen
dem catch dem. The bad guy say na 2 times he don follow him pipu go
thief o, and the first time na 7k dem give am from inside. He say he
bin dey drive for one plastic compamy before dem sack am, and na wetin
make am broke be that, na so he go jam the gang for one beer parlour
where dem blend am enter robbery level.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment